Submitted by daniel on Tue, 21/07/2026 - 11:58 Picture Image Description Who dey UK Prime Minister Andy Burnham cabinet? Published 6 hours wey don pass Read am in 4 mins Andy Burnham dey announce im Cabinet afta dem swear am in as Prime Minister. Di Makerfield MP, wey no bin wan tok about who e go choose, now don begin announce di pipo wey go help set di direction of im govment. On Friday, di former Greater Manchester Mayor bin insist say e neva make any decision about im top team, but rumours still dey spread about who go occupy di top government offices. Pipo believe say Mr Burnham bin dey consider either Energy Secretary Ed Miliband or Home Secretary Shabana Mahmood to bicom Chancellor, as many pipo expect Rachel Reeves to leave di position. Earlier, Lord James Timpson bicom di first minister wey resign from govment bifor oga Burnham cabinet reshuffle. Di former chief executive of Wythenshawe-based Timpson Group bin bicom prisons minister for July 2024. MP Steve Reed also step down as Housing Minister. For im resignation letter, di MP for Streatham and Croydon North say Sir Keir Starmer show loyalty to am by appointing am into Cabinet, adding: "I make no apology for returning dat honour." Lord Patrick Vallance, wey im ministerial portfolio include science, innovation, research and nuclear, follow Lord Timpson resign. E serve for both di Department for Science, Innovation and Technology and di Department for Energy Security and Net Zero wey Ed Miliband lead during Sir Keir premiership. List of cabinet wey Burnham appoint Web Link Andy Burnham cabinet: John Healey, Angela Rayner, Rachel Reeves, Miatta Fahnbul… BBC